Account
Funny Quotes and Jokes πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

Funny Quotes and Jokes πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

>It's all about laughter. >React and comment on our post. >Please help us to share so as to put laughter on other people's face too. >Please don't share any link here to avoid getting removed and banned.

Username
@funnyquotesandjokes
Category
Humor and entertainment
Country
NigeriaNigeria
Subscribers1,990
Avg views per post, 7dβ€”last 7 days
ERR14.07%30-day average

Average views per post by day

By publication day

Show as table
DateAvg views per post
Nov 4, 2026369
Nov 17, 2026191

Most viewed this month

  1. 01

    No text

    Photo
    Views371
    Forwardsβ€”
    Reactionsβ€”
    Commentsβ€”
  2. 02

    No text

    Photo
    Views367
    Forwardsβ€”
    Reactionsβ€”
    Commentsβ€”
  3. 03

    Years ago, when I dey SS3, I dey date one girl wey don finish SS3, her mama dey sell pepper. I no fit carry her come house, na for their place we dey see. Her papa na driver wey dey always travel. The house wey dem dey live na room and parlor self contain wey be say na only one door you fit take enter the apartment, come enter the room. One day, as usual, she temme say her mama don go market go buy pepper and once she go like that, na late night she dey come back. As 10 oclock nak, I bribe our gateman japa comot for skool. She don cook rice and stew for me, put one bottle of Limca. I comot my school uniform(shirt) balance for chair with singlet and short, begin chop while she sit down beside me. We dey watch Music Africa for Silver Bird television. Suddenly, naso we hear her mama voice wey dey call her. E first be like feem for our eyes...πŸ™†πŸΏβ€β™‚οΈchisos! She don dey waka come the door and their passage small, no where to run. I first confuse. Shit and piss hold me together, I begin fart anyhow. Naso she drag me enter room, temme make I hide for back of the door wey link parlor to room. She quickly pack my sandal(i no dey leave am for outside) and my shirt gimme. I stand there dey breathe like pesin wey wan give up. At the back of the door, one small line dey there. Dem spread different kinds of pant and bra, omo, dem look scary. Pant wey be like zombie mask. I hear one hot slap. Na d mama give my babe slap say why she dey auz instead of shop. She order am make she dey go immeadiately. Naso d woman enter house oh. She first sit down for parlour, see food. She say eh, so this girl dey use her pepper money dey cook, enjoy herself. She finish the food, gulp the limca, belch like pig. She enter room begin sing. I no fit peep, but the sound wey I hear, I know say she dey change. I come dey pray make she no come back of door. After sometime, she comot, close door. I waka sharperly go door make i comot run, I see say she don lock door. I come begin hear sound say person dey baff. I sit down for chair hold my head wey dey hot say which kain wahala be this one like this. I kum reason am say, this woman fit wan carry pant and bra for back of door oh. Naso I enter run under bed. Na her leg I dey see. Heat and dust wan end my life. She change finish, sit for bed dey count money. I dey use hand pack my sweat make e no flow come outside. When she finish to dey count money. She begin write about her business. I wan dye. Wetin pain me pass be say, this stewpid girl no even come back come help me somehow, she just lemme to my fate. E reach about two hours before she stand up, comot for house again, lock door. When I comot from under the bed, breeze first blow me trowey, I nak head for wardrobe. E reach five minutes before I see well. Blood no dey flow reach my brain wen i dey under d bed. I look myself for mirror begin cry say wetin be this? From head to feet, I don detty...detty December πŸ˜‚ I dey parlour for about one hour before I hear footsteps again, I run go back under the bed. She come enter, call me. I crawl out from under bed. When she see me, she first drop her jaw come tear laff. E be like make I shooot her for belle. As I say make I dey go, I hear her mama voice again. She say make I enter under bed again, I say no be me. I no ready to die. I run go back of door. The woman send my girl make she go stay for shop say she wan change. AGAIN!!!? I know say, it is time, na do or die I dey. I know say she go come that door, I come ready myself. I shine my big eyeballs, come open teeth wide, come raise my two hands like small pikin wey wan do like demon...I come be like fresh skeleton wey wear skool uniform. As d woman push the door make she carry bra, Naso I scream "Huuuuuuurrrrrhhhhhh!!!!!" D woman scream, stagger comot, I pick race, comot for the auz, run go backyard, jump fence, land inside bush. I no know say thorn and akugbara leaves(craw craw leaves) dey there. Na for their midst I land.

    Text
    Views193
    Forwardsβ€”
    Reactionsβ€”
    Commentsβ€”
  4. 04
    Views189
    Forwardsβ€”
    Reactionsβ€”
    Commentsβ€”

Latest posts

#6543Text

Open in Telegram
Views193βˆ’31%vs avg
Forwardsβ€”
Reactionsβ€”
Commentsβ€”
#6535Text
Views855+205%vs avg
Forwardsβ€”
Reactionsβ€”
Commentsβ€”

All posts

Connections