Thorn first design my face, hand, leg and yash, but I no mind because the woman dey scream and I dey fear make search rescue no go dey. Na wen I comot for the bush enter street, pretend say I dey come from school, na him I begin feel say I don use body rub akugbara leaves...oh my my...oh Lawd...make I stop here...make I stop...because I suffered 😢 😭...
Открыть в Telegram
Funny Quotes and Jokes 😂😂😂
>It's all about laughter. >React and comment on our post. >Please help us to share so as to put laughter on other people's face too. >Please don't share any link here to avoid getting removed and banned.
Средние просмотры поста по дням
По дню публикации
Показать таблицей
| Дата | Просмотров на пост |
|---|---|
| 4 нояб. 2026 г. | 369 |
| 17 нояб. 2026 г. | 191 |
Самые просматриваемые за месяц
- 01Просмотры371Пересылки—Реакции—Комментарии—
- 02Просмотры367Пересылки—Реакции—Комментарии—
- 03Просмотры193Пересылки—Реакции—Комментарии—
- 04Просмотры189Пересылки—Реакции—Комментарии—
Новые посты
Years ago, when I dey SS3, I dey date one girl wey don finish SS3, her mama dey sell pepper. I no fit carry her come house, na for their place we dey see. Her papa na driver wey dey always travel. The house wey dem dey live na room and parlor self contain wey be say na only one door you fit take enter the apartment, come enter the room. One day, as usual, she temme say her mama don go market go buy pepper and once she go like that, na late night she dey come back. As 10 oclock nak, I bribe our gateman japa comot for skool. She don cook rice and stew for me, put one bottle of Limca. I comot my school uniform(shirt) balance for chair with singlet and short, begin chop while she sit down beside me. We dey watch Music Africa for Silver Bird television. Suddenly, naso we hear her mama voice wey dey call her. E first be like feem for our eyes...🙆🏿♂️chisos! She don dey waka come the door and their passage small, no where to run. I first confuse. Shit and piss hold me together, I begin fart anyhow. Naso she drag me enter room, temme make I hide for back of the door wey link parlor to room. She quickly pack my sandal(i no dey leave am for outside) and my shirt gimme. I stand there dey breathe like pesin wey wan give up. At the back of the door, one small line dey there. Dem spread different kinds of pant and bra, omo, dem look scary. Pant wey be like zombie mask. I hear one hot slap. Na d mama give my babe slap say why she dey auz instead of shop. She order am make she dey go immeadiately. Naso d woman enter house oh. She first sit down for parlour, see food. She say eh, so this girl dey use her pepper money dey cook, enjoy herself. She finish the food, gulp the limca, belch like pig. She enter room begin sing. I no fit peep, but the sound wey I hear, I know say she dey change. I come dey pray make she no come back of door. After sometime, she comot, close door. I waka sharperly go door make i comot run, I see say she don lock door. I come begin hear sound say person dey baff. I sit down for chair hold my head wey dey hot say which kain wahala be this one like this. I kum reason am say, this woman fit wan carry pant and bra for back of door oh. Naso I enter run under bed. Na her leg I dey see. Heat and dust wan end my life. She change finish, sit for bed dey count money. I dey use hand pack my sweat make e no flow come outside. When she finish to dey count money. She begin write about her business. I wan dye. Wetin pain me pass be say, this stewpid girl no even come back come help me somehow, she just lemme to my fate. E reach about two hours before she stand up, comot for house again, lock door. When I comot from under the bed, breeze first blow me trowey, I nak head for wardrobe. E reach five minutes before I see well. Blood no dey flow reach my brain wen i dey under d bed. I look myself for mirror begin cry say wetin be this? From head to feet, I don detty...detty December 😂 I dey parlour for about one hour before I hear footsteps again, I run go back under the bed. She come enter, call me. I crawl out from under bed. When she see me, she first drop her jaw come tear laff. E be like make I shooot her for belle. As I say make I dey go, I hear her mama voice again. She say make I enter under bed again, I say no be me. I no ready to die. I run go back of door. The woman send my girl make she go stay for shop say she wan change. AGAIN!!!? I know say, it is time, na do or die I dey. I know say she go come that door, I come ready myself. I shine my big eyeballs, come open teeth wide, come raise my two hands like small pikin wey wan do like demon...I come be like fresh skeleton wey wear skool uniform. As d woman push the door make she carry bra, Naso I scream "Huuuuuuurrrrrhhhhhh!!!!!" D woman scream, stagger comot, I pick race, comot for the auz, run go backyard, jump fence, land inside bush. I no know say thorn and akugbara leaves(craw craw leaves) dey there. Na for their midst I land.
Открыть в TelegramToday a pastor told the usher to throw one boy out cause he was dancing near the offering box 🌚🌚🌚 Happy Sunday my people
Открыть в TelegramDear Parents, after you have paid all the school fees including fees for books for all your children, remove just N5,000.00/N10,000.00 from your account. Take a walk to the Mallam selling Roasted chicken or fish and order for 2 laps of chicken or one plate of fish. Tell him to package it in a "TAKEAWAY". On your way home, buy Hollandia yogurt, or any good yogurt, Coke or any of your favorite drink. When you get home, Lock your door, undress yourself to feel free. Put on the fan. Put "I can't kill myself" by Timaya or any of your best songs. Please don't sit on the chair, spread on the floor and make sure you tear that chicken/fish as you listen to the song. Then step it down with your drink. One thing you need to know is that, Problem no dey finish for this world. So no kill yourself trying to solve everything without taking a break to relax and enjoy your life. Many people ended up in the grave without eating 10% of their sweat. Look after yourself first before anything else. A dead person doesn't hustle again. It's already 17th day of September and the problems of 2023 still full ground!🙇🏾♂️🙇🏾♂️🙏🏾 But God will surely make a way.🤓🤝👊
Открыть в TelegramСвязи
Похожие каналы
BBNaija Updates & TIA Stories 🔞@tiastoriesЮмор и развлечения11,3 тыс.
Кончание ягнят 💦@yagnen0chekЮмор и развлечения1,99 тыс.
Пупырки 🥳@pupyrkatgЮмор и развлечения1,99 тыс.
نهفات عربية@syria1moatnЮмор и развлечения1,99 тыс.
Lark@larkovanieЮмор и развлечения1,99 тыс.
Беды с башкой@vedysboshkoyЮмор и развлечения1,99 тыс.
4eH4HR : xiHkaJli 3 pyzzkix чченян ченчня 🏳️🌈@go_to_pizda_putin_huiloЮмор и развлечения1,99 тыс.
Лимонные мемы@limonnyymemeЮмор и развлечения1,99 тыс.